London Olympics 2012 - Ma Country People, Wetin Happen Na

Started by emezico, Aug 07, 2012, 10:04 PM

emezico

MA COUNTRY PEOPLE, WETIN HAPPEN NA?

Small thing Ogoni man go jump enter water like fish. See olympics go swim, ZERO medal.

Hausa man go enter boat dey shout argungu fishing festival. See rowing at the olympics, ZERO medal.

Fulani herdsmen fit shoot arrow from 1km kill anyone wey wan steal dem cow, olympics reach make dem go do archery dem no gree show face

Igbo man will run from Sokoto to Aba at the slightest provocation by Boko. See long distance running at the olympic, ZERO medal.

Agbero for park no mind pursue bus for road. See 100meters race at Olympics, ZERO medal.

Yoruba man will remove clothe, wrist watch and pant to fight at Ojuelegba. See boxing for olympics, Zero medal.

Warri man go say Warri no dey carry last...wetin Blessing Okagbare, our own Warri girl dey do for last na?

**JUSTSAYING**