Na so I dey waka my own for raod jeje dey enjoy ma life when I take corner eye see one aboki dey wrapp im mobile phone wit a hanky. I dey wonder come do amebo ask am , oga wetin you dey do na? He say " walahi , I wan call my brooda for kano, e dey owe me moni, so I wan hide my number make e no know say na me bcos if e seee my number he no go pick the phone. Abeg oo, laugh don make me wan go bath on top transformer!