The InfoStride Forum

GENERAL DISCUSSION => Chit-Chat (Gossips) => Topic started by: Emmy Baba on Aug 26, 2012, 03:43 PM

Title: Naija Ninja
Post by: Emmy Baba on Aug 26, 2012, 03:43 PM
Naija Ninja!

Na Naija you fit win Aeroplane by loading 200 Naira Mtn Card # Stupid Promo#
(very soon Etisalat go say recharge 200 and win the country as a whole)

Na Naija you go see fish inside Meatpie #name abuse#

Na 4 Naija native doctor dey laugh (hahaha) and he godetect the problem #deceit#

Na 4 Naija  Blackbery dey show 3G but no network.. #fake#

Na 4 Naija ja we dey count money wey we withdraw for atm #doubting d machine#
.
Na 4 Naija Pharmacy dey sell coke, Recharge Card, chin chin and beer #jack of all trade#
Title: Re: Naija Ninja
Post by: Becky02 on Aug 27, 2012, 11:52 AM
What man go do nao? Na him be say naija rock be dat oo. ℓ☺ℓz