Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading #200 MTN Recharge Card.
Very soon Etisalat go say recharge #200 and win a big ship.
Then Airtel go com follow sey, recharge #100 an win benin republic.
Glo go just kuku say... Recharge 500 and win Nigeria bcos there colour na Green
Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE"
Na only for nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines.
Na only for Nigeria PHCN dey say: Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill
Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green
Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff, Ogogoro and beer.
Pugo you are funny!!!