The InfoStride Forum

ENTERTAINMENT and ADVENTURE => Jokes and Comedy => Topic started by: KingFemzee on Mar 05, 2013, 07:36 PM

Title: Hilarious: Akpors and Emeka
Post by: KingFemzee on Mar 05, 2013, 07:36 PM
Emeka: U be fool, u no sabi nothing.

Akpos: Ahhh...haba guy

Emeka: Na so. I fit prove am sef. If na night and u see 2 light for road, na wetin be dat?

Akpos: Na moto.

Emeka: Ehenh, but wish kind? Benz? Peugeot? or Lexus?

Akpos: I no know dat 1 oh!

Emeka: U see am. Anyway, second proof. Na night, u see 1 light for road. Na wetin be dat?

Akpos: Na okada.

Emake: Ehenh, wish one? Suzuki? Yamaha? or Kawasaki?

Akpos: Ahh....how I suppose know?

Emeka: U see am? I don show u say u be fool.

Akpos: Na wa 4 u o. Dis ur question sef. Oya make I axe u. If na night u see woman for roadside....mini skirt, big breast, red lips, big nyash,na wetin?

Emeka: Na ashawo na.

Akpos: Ehenh, but which one? Ur mama, ur sister or ur daughter?

#Lobatan
Title: Re: Hilarious: Akpors and Emeka
Post by: Emmy Baba on Mar 05, 2013, 10:35 PM
Akpors finish Emeka, no be small... Warri man vs Ibo man. Lol...
Title: Re: Hilarious: Akpors and Emeka
Post by: KingFemzee on Mar 06, 2013, 03:25 PM
Emeka no know say Warri no dry carry last.