The InfoStride Forum

ENTERTAINMENT and ADVENTURE => Jokes and Comedy => Topic started by: joker on Apr 28, 2014, 01:31 PM

Title: Hilarious Joke - Hungry Rat
Post by: joker on Apr 28, 2014, 01:31 PM
Conversation between Akpos and a rat:

RAT: (With a tiny voice) Hello.

MAN: Hello, who am I speaking with?

RAT: Na Mr Akpos be dis abi?

MAN: Yes! You are speaking wit Mr Akpos. Who is dis please?

RAT: So you no recognize my voice abi? Na, me your room mate.

MAN: You say what?

RAT: Your room mate, Rat. I dey your room now.

MAN: I beg your pardon?

RAT: Which yeye beg you dey beg. I never chop since yesterday wey you waka comot. I check that place wey you dey put food I no see anything. I check the kitchen, nothing! I even check your fridge, no single food there! E be like say you wan kill me abi? No problem, I just say make I let you know say that your certificate for inside your wardrobe wey dem write 'LAGOS STATE UNIVERSITY', I don eat the "LA" comot. Remaining"GOS" STATE UNIVERSITY. Let me see which work you go take "GOS" state university find (Rat ends call).

What do you advice Akpos should do?