The InfoStride Forum

ENTERTAINMENT and ADVENTURE => Jokes and Comedy => Topic started by: Emmy Baba on May 11, 2012, 04:07 PM

Title: Funny Joke: Warri Boy Funny Dreams
Post by: Emmy Baba on May 11, 2012, 04:07 PM
One day my papa call me and my brother for domot, he tell us say if we dream say them wan give us something for dream make we no collect, say na enemies wan give us bad things. He say if we dream that kind dream make we tell am and he go buy that thing wey them wan give us for dream for us.

Two days later my brother sleep for night dey mention RICE! RICE!! RICE!!!, ma papa wake am say ......wetin dey happen, he say them wan give am rice for dream. My papa give am #500 say make he take eat rice.

When i see say the thing dey work... The next day i start to dey shout MR BIGGS!!! for night. Ma papa say wetin, i say them wan gimme Mr Biggs for dream. My papa gimme #1000 make i take eat Mr Biggs. Na so i do wey i take buy my phone and bicycle. But the one wey i do wey i take spoil evrything na for one night wen i dey shout RANGE ROVER!!!, ma papa wake up say wetin... I say them wan gimme RANGE ROVER for dream.

My papa TEAR ME SLAP kon shout ''why you no resemble me? oya foward match go back to sleep make you go collect am". LMAO!!!
Title: Re: Funny Joke: Warri Boy Funny Dreams
Post by: emezico on May 11, 2012, 08:26 PM
Laugh won kill me die....LWKMD!!!
Title: Re: Funny Joke: Warri Boy Funny Dreams
Post by: Engr Jidex on May 11, 2012, 10:13 PM
A don nearly die
Title: Re: Funny Joke: Warri Boy Funny Dreams
Post by: Olaniyi Isaac Oluwaseun on May 14, 2012, 08:42 AM
Laughs.... I dey get tears of laughter.
Title: Re: Funny Joke: Warri Boy Funny Dreams
Post by: Saheed Adebayo on May 14, 2012, 10:59 AM
What a nice joke!!!
Title: Re: Funny Joke: Warri Boy Funny Dreams
Post by: Amynwan on May 16, 2012, 02:48 PM
 :D hahahaha warri people abeg make una no kill person for here o. thats a gud one, keep it up.
Title: Re: Funny Joke: Warri Boy Funny Dreams
Post by: Omolewa akinyemi benson on Jun 07, 2012, 02:03 PM
OMG!!! Haahahahahahahahaahahahahahahahahahahaahhaahahahahahahahahahahahahhahaha