The InfoStride Forum

ENTERTAINMENT and ADVENTURE => Jokes and Comedy => Topic started by: Jobbers on May 29, 2012, 09:42 PM

Title: Funny Joke: Psalm 23 In Pidgin English
Post by: Jobbers on May 29, 2012, 09:42 PM
(http://www.theinfostride.com/cdn/img/jokes.jpg)
1.The Lord na my shephard, i dey kampe.

2. E make me sidon for where betta dey flow, and come put me next to stream make my bodi thermacool.

3. E panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness sake of Him name.

4. Walahi !, even if I waka pass where Boko Haram, arm robber, 419 and juju people gather, come even join okada and trailer reach valley of the shadow of death sef, my bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so dem dey like back bone dey comfort me.

5. You don prepare Egusi and Pounded yam make I chop. All my enemies jus sidon dey look waa waa waa like Dog. You rub me for head with vaseline intensive lotion & Goya olive oil. my cup con overflow lik bar beach water.

6. True true, beta life & mercy go de folo folo me 4 back till I quench and man pikin go stand fit lik elephant 4 God house from lai lai till lai lai...
Title: Re: Funny Joke: Psalm 23 In Pidgin English
Post by: Davzy folamz on May 31, 2012, 12:08 PM
This is very hillarious.
Title: Re: Funny Joke: Psalm 23 In Pidgin English
Post by: Davzy folamz on May 31, 2012, 12:14 PM
I love naija language.
Title: Re: Funny Joke: Psalm 23 In Pidgin English
Post by: Jumoke benson on Jun 01, 2012, 12:34 AM
Pidgin is the best language on earth.
Title: Re: Funny Joke: Psalm 23 In Pidgin English
Post by: Jumoke benson on Jun 01, 2012, 12:35 AM
Pidgin is the best language on earth.
Title: Re: Funny Joke: Psalm 23 In Pidgin English
Post by: Omolewa akinyemi benson on Jun 05, 2012, 07:26 PM
Very funny 1.I like it.
Title: Re: Funny Joke: Psalm 23 In Pidgin English
Post by: Jumoke benson on Jun 09, 2012, 11:41 AM
Funny psalm ooooooo