The InfoStride Forum

ENTERTAINMENT and ADVENTURE => Jokes and Comedy => Topic started by: olagenesis on Sep 22, 2012, 07:24 PM

Title: Funny Joke: Only In Nigeria!
Post by: olagenesis on Sep 22, 2012, 07:24 PM
Na only 4 naija you fit win Aeroplane by loading N200 MTN card!
Very soon Etisalat go say recharge N200 & win a big ship!
Then Airtel go come follow say, recharge N100 and win Benin
Republic.
Glo go just kuku say
recharge N500 and win Nigeria, bcoz there colour na green!
Na only Nigeria you go see fish
inside "MEATPIE."
Na only 4 Naija we dey count money after we withdraw am
from ATM machines!
Na only 4 naija PHCN dey say, win a brand new Generator if you pay up your electricity bill.
Na only 4 naija people dey horn 4 traffic light make e quick change
from red to green.
Na only 4 naija pharmacy dey sell
coke,recharge card, chinchin, puffpuff, ogogoro & beer.
Wetin you no fit see 4
anoda country, e dey happen 4 here..
A beg make u add your own joooo.
Title: Re: Funny Joke: Only In Nigeria!
Post by: Nifemi Donald on Sep 22, 2012, 10:38 PM
Specially designed things will only happen in Naija. Things here are always different and classy
Title: Re: Funny Joke: Only In Nigeria!
Post by: Sunexx360 on Sep 22, 2012, 10:54 PM
Because Nigerian is really blessed with alot of things
Title: Re: Funny Joke: Only In Nigeria!
Post by: KingFemzee on Sep 23, 2012, 01:10 AM
lwkmd.....i cant stop laughing, Naija which way?
Title: Re: Funny Joke: Only In Nigeria!
Post by: Stanley_13001 on Sep 23, 2012, 06:08 PM
9ja for life. anytin can happen
Title: Re: Funny Joke: Only In Nigeria!
Post by: Folami David on Sep 24, 2012, 12:55 AM
God, nigeria is in your hands o.we need rapid change