BETWEEN AKPORS AND EMEKA
Emeka: U be fool, u no sabi anything.
Akpors: Ahhh...haba guy.
Emeka: Na so. I fit prove am sef. If na night and u see 2 light for road, na wetin be dat?
Akpors: Na moto.
Emeka: Ehenh, but wish kind? Benz? Peugeot? or Lexus?
Akpors: I no know dat one oh
Emeka: U see am. Anyway, second proof. Na night, u see 1 light for road. Na wetin be dat?
Akpors: Na okada.
Emeka: Ehenh, whish one? Suzuki? Yamaha? or Kawasaki?
Akpors: Ahh....how I suppose know?
Emeka: U see am? I don show u say u be fool.
Akpors: Na wa 4 u o. Dis ur question sef. Oya make I ask u. If na night u see woman for roadside....mini skirt, big breast, red lips, big nyash, na wetin?
Emeka: Na ashawo.
Akpors: Ehenh, but which one? Ur mama, ur sister or ur daughter?
Who come be fool?
Akpor will never come last in that type of argument now? abi you no trust him, na pure waffi guy him be.
Akpos did not retaliate.he only insulted Emeka.I hope Emeka understood what he said so they can begin the fight