Funny Joke: Akpors the Church Interpreter

Started by nReporter, Feb 16, 2013, 08:00 AM

nReporter

Akpors was chosen as the church interpreter last Sunday. Read his funny interpretation below:

Pastor: As it was in the bible.

Akpors: As dem yarn am for bible.

Pastor:  Jesus entered the boat with his disciples

Akpors:  Na im Jesus fall in and arrange for canoe with him pally dem

Pastor:  As the boat was sailing there was a great storm

Akpors:  As the canoe dey move na im yawa come gas

Pastor:  the storm was so great that it was like a whirl wind

Akpors:  de yawa come de so tay, kasala burst enter

Pastor:  the disciples were now afraid and they shouted master master

Akpors: na im pally dem liver drop, dem begin hala, "bros e, bros e

Pastor:  Jesus got up and calm down the wind

Akpors: Na im Jesus tanda, come arrange de yawa

Pastor:  He turned to his disciples and said, you are men of little faith

Akpors: Na so Jesus look im pally dem, shake head, tell dem say "NNA
MEN, UNA FALL MY HAND ON PER SECOND BILLING.

Can you rate Akpors with his hilarious interpretation?

Shola Sholaz

akpos should never enter a church again. he is a sinner