Funny Joke: A test for Akpos

Started by olagenesis, Jul 22, 2012, 01:11 PM

olagenesis

Akpos was asked to
complete the following:
.
.
.
1)He who fights n run
away?
Akpos: e don surrender be
dat na, na fear catch am.
2)A rolling stone?
Akpos: No fit just dey roll,
na person push am.
3) He who lives in a glass
house? Akpos: Na rich
politician e go be.
4)A stitch in time?
Akpos: dey prevent
further tear tear.
5) Birds of d same
feather?
Akpos: Na d same mama
born them.
6) One good turn?
Akpos: Na correct power
steering fit do am.
7) A bird in hand?
Akpos: Wetin e wan be
again if nobe barbeque.
Dem plenty for chicken
republic.
8) Half bread is better
than?
Akpos: Puff puff, buns or
garri without sugar.
9) A journey of a
thousand miles? Akpos:
Na d person wahala be
dat na, Why e no enter car
or
aeroplane jeje?
10) He who laughs last?
Akpos: Get brain problem.
Make dem examine am
becos na begining of
madness be dat.
11) A patient dog?
Akpos: Na hunger go kill
am.
12) All work and no play?
Akpos: Na bank job be dat
bros.
13) Once beaten?
Akpos: Na revenge go
follow b dat.
14) A fool at forty? Akpos:
U never see Naija own,
ours starts @ 50.
15) A friend in need?
Akpos: Na parasite b dat.
Will akpos pass the
test ???

Motivational Tunrayo

I never knew akpos was this intelligent.I give you 110/100 for this.You are over correct in all of them.Your teacher just want to spoil your shine.