Local Proverbs... Waffi Version

Started by MyWorld, Oct 21, 2009, 01:08 PM

MyWorld

He who fights and runs away.... Na fear catch am

Pikin wey no sabi em mama boyfriend... dey call am brother

A rolling stone no just dey roll... Na person push am.

He who lives in a glass house....... Na im pepper rest

A stitch in time........ dey prevent further tear tear.

Birds of the same feather...na the same mama born dem.

One good turn......... na correct power steering be that.

A bird in hand........ na barbeque be dat.

Half bread.......... is better than puff puff.

Journey of a thousand miles....... Ol'boy e beta make u carry your car go or enter aeroplane

He who laughs last........ na mumu. Why im no catch the joke at the first time and laugh when others dey laugh?

The patient dog........ Na hunger go kill am.

All work and no play......Na banker be dat

All play and no work...... Abeg na real life be dat. After all I see as u happy wen dem declare holiday'

Tade olaitan


Jafar Anka


Samo gideon

Warri things are always hillarious.

Segun fadare


Davzy folamz

the way things are translated nowadays...lmao