Funny Joke: Mrs Akpors Confronts Her Housemaid

Started by emezico, Jul 25, 2012, 09:07 PM

emezico

Mrs Akpors - a housewife realizing that the housemaid - Chinyere had started behaving funny decided to engage her one morning.

Mrs Akpors: "Chinyere why u dey behave anyhow these days? Abi u dey craze self? E be like say u no wan know ya mate for this house again o. U carry craze for head? Abi face no dey fear face for ya village?"

Chinyere: "Look at you, which kind wife wey u be? After all my food dey sweet pass your own...."

Mrs Akpors: "Ehn who tell you say you cook pass me?"

Chinyere: "Oga now..."

Mrs Akpors: "Lord have mercy. Papa Nkem go come meet me for this house... Na war between me and am today. Oooh no wonder... I dey suspect since..."

Chinyere: "I even better pass u for bed..."

Mrs Akpors: "Yeeppaaaa.. I'm finished. So...na papa Nkem dey tell u all that?"

Chinyere: "No ooo! Na the driver tell me."

Mrs Akpors: "Uhmm Chi baby, Chinyerry, Chinlosky...come here ehn... Good girl. Abeg no let Oga hear that one. OK...."

Tina lawrence

Next time, Mrs Akpos will leave her housemaid in her place.Her inquiring skillz has put her in trouble now

Amynwan

hhahahahaha. yeye madam wey no give  herself respect, how will house maid respect her.

Folami David

the housemaid should not answer o,mr akpos must hear

Nifemi Donald

that akpos friend is a bad man o.two women living under the same roof