Hilarious: Akpors answer to Waec questions

Started by KingFemzee, Mar 06, 2013, 03:46 PM

KingFemzee

WAEC examination, Akpors was asked to complete the following:

1. He who fights and run away?
Akpors: E don surrender be dat na, na fear catch am.

2. A rolling stone?
Akpors: No fit just dey roll, na person push am.

3. He who lives in a glass house?
Akpors: Na rich politician e go be.

4. A stitch in time?
Akpors: Dey prevent further tear tear.

5. Birds of the same feather?
Akpors: Na the same mama born them.

6. One good turn?
Akpors: Na correct power steering fit do am.

7. A bird in hand?
Akpors: Wetin e wan be again if no be barbeque. Dem plenty for chicken republic.

8. Half bread is better than?
Akpors: Puff puff, buns or garri without sugar.

9. A journey of a thousand miles?
Akpors: Na d person wahala be dat na, Why e no enter car or aeroplane jeje?

10. He who laughs last?
Akpors: Get brain problem. Make dem
examine am, becos na begining of madness be dat.

11. A patient dog?
Akpors: Na hunger go kill am.

12. All work and no play?
Akpors: Na bank job be dat bros.

13. Once beaten?
Akpors: Na revenge go follow be dat.

14. A fool at forty?
Akpors: U never see Naija own, our own
starts @ 50.

# :)