David Numba One To Replace Alex Ferguson

Started by Folami David, May 08, 2013, 09:28 PM

Folami David

Bookmakers don start dia own parade as dem dey yarn say na Everton manaja David go replace Alex Ferguson, wey bin anounse say in go retire as Oga of Manchester United on Wednesday afta in do 26 years for dia win plenti cup join.
.
Moyes na im be odds-on favorite wit plenti Britain bookmakers jus as Ferguson bin anounse say in dey waka for statement wey comot for the club website, and the odds sef don dey drop small small.
.
David Moyes wey b Ferguson broda from Scotland don dey for Merseyside nearli reach ten years and don dey try well well wit the small kisi wey in get to spend.
.
Real Madrid coachi Jose Mourinho don also dey dia list to take kollect the work.
.
The Portugal guyman don dey clear road to take waka go bak Chelsea afta all the gbege wey in get wit in playas for Spain and now e be like say notin dey again dan to waka comot go bak in foma club.
.
Mourinho and Moyes na Ferguson paadi tey tey, as the coachi wey go retire wen seasin kpai go become Manchester United club direkto and ambassador afta in las match wen dem play West Bromwich Albion for May 19.