Bad Market!

Started by emezico, Jul 25, 2013, 03:14 AM

emezico

Bad Market is when you go in front of White Garment Church to sell shoe or slippers,... I ask you, Cele-church dey wear shoe.

Bad Market is when you dress to go church come wear PINK top with BLACK skirt/trouser, but as you bounce enter church, you come see say na dat your colour una Church Choir wear dat sunday. As you come siddon for back, people come dey look you as one Choir member wey dey under suspension.

Bad Market is when you chop the only fish head (isi-azu/ori-eja) wey remain for pot of soup, without knowing say na that fish-head your Malleh wan take arrange nite-food for your Palleh.... My dear, na that nite your Papa go disown if you no vomit that fish-head.

Bad Market is when a lady dey sleep come dey dream where she dey give birth for hospital bed. The nurses come dey tell her pussssssssh, she just dey push dey go. When she finally woke up, she come see say na shit she dey shit for bed.

Bad Market is when you as a guyman, ask a girl to give you her number after toasting her, she come give you her papa number. You come decide to call her at midnite for romantic chat... My dear your name go turn to "error in connection".

Bad Market is when you don arrange your room finish, come lie down on top of bed dey wait for one chikala wey you invite to your house. As you hear knock on, naso you rush as sharp guy go open door thinking say na your latest chikala, you come see say na your Landlord wey you dey owe 14months house rent.

Bad Market is when you mistakenly use weed (igbo leaf) cook jellof-rice thinking say na scent leaf or curry leaf... My dear, na Fela or Bob Marley go wake you up for New York when you eat the rice finish.

Bad market is when you as a babe, follow guy go joint, you just dey chop every every, infact all the gbogbontigbo na your belle e enter, isiewu, point and kill, cowtail and gaot meat pepper soup, peppered snail, fried peppered meat, fried peppered gizzard and fried peppered turdey,...you even drink red wine, akpeteshi, opaeyin, odeku, palmwine, sapele water, infact ehn, you just guzzle everything down, the guy sef pay, una come enter room you come dey form for the guy say you dey do menses, omo na their you go sabi say gobe dey get gator.

Bad market is when, as a gallant babe your mother slaps you, you just hiss and walk out on her due to annoyance BUT your boyfriend beats you blue black and yet after the beating, you will still become a sanitation worker in his house then afterwards you'l update you PM thus:::my boyfriend brings out the best in me.....truth ehnnn, na Amadioha go personally treat your f**kup

Bad market is when you do runs for school, enter party wen be say dem don organise sugar daddy/mummy wey dey wait you for inside room, you enter the room after you don manya sotey your eye don dirty but as you just enter the room, na your palleh/malleh be the sugar daddy/mummy wey dem arrange you for. Hmmm e don red be that.

Bad market is when you find yourself in Aluu on a friday morning, stealing a glimpse at a pretty babe.....mehnnn na Aluu5 dey load for your neck be that because na you dem go take complete am Aluu5.

.......Oya knack us your own idea of Bad market

Shola Sholaz

This is more than true. There are loads of bad market scenarios in this country and u've just listed a few. Very funny and hillarious I must say.

femifemzy3

Hehehehehe If this Bad Market then i never want to experience bad market o.