Save OJB Jezreel - Pigin English Warning

Started by emezico, Jun 27, 2013, 09:40 AM

emezico

OJB is batlin wit a kidney problem. A donor hs been found & he's in need of $100k(N16m) 2 carry out d operation.-

Chezzy donated 100k to OJB kidney transplant Oya, all of u big boys in d industry cme out & help ur colleague. Dont wait 2 enter studio 2 sing tribute song. We no go buy am. Na all ur songs dey mention say una get stupendous wealth, oya help ur broda.

Wizkid (wey say N500k na chicken and chips)oya come help ur brother. We knw say "ur money & their money no be mate". Omo jaiye-jaiye,No buy anoda N50m Porsche, Save a life.

D'banj and his $50k watch,$20k suit. No look ur broda mak im die. Eja nla open ur Versace wallet.

Iyanya u just sign N60m contract wit MTN. .Al we nid now is ur change not ur waist.

2face, abeg come spend some of this Dubai money. Na this man produce d song(African Queen) wey launch you o.

Don Jazzy and his N60m Porsche, abeg drop something.

Davido (OBO), u don get enough gold chain o.

P-square and dem mansions and jet, biko drop something 4 ur guy.

Banky W, Eldee, Dr Sid, Olamide, Wande coal, Timaya, May D, Burna Boy, Ice price, MI, D'Prince - na all of una dey sing say una dey swim inside money o. No allow this man die o.

If una no drink Champagne for 1 weekend una no go die o. abeg gather money help this man. All of you wey i mention, if una fit contribute N1m each money don complete be dat o..

If this man die, shame on all of una!